Okpebholo dash Edo Queens N50 million afta dem win WAFU bicos dem too try.
Edo state oga, Monday Okpebholo, don yan N50 million give Edo Queens players plus their oga dem after the team knack big win for 2026 WAFU B Women Champions league. The governor yan for government house, Benin City, during one ceremony wey dem dey present the team both the 2025/26 Nigeria Women’s Football League (NWFL) trophy and the 2026 WAFU B Women’s Champions League title.
Edo queens dem show strong spirit for di final match wey dem play against di Ghana club Ampem Darkoa Ladies. Di match finish 2-2 after normal time, but Edo Queens no gree lose for penalty shootout. Dem knack Ghana side 4-1 for penalties, di goalie do big work, e save plenty ball and dey pressure di Ghana players well well.
Governor Okpebholo praise the players for their courage, discipline and determination throughout the competition. He also commend the goalkeeper, coach, technical crew and management for their hard work. The governor say the victory no be only for Edo State but also something wey Nigeria people fit celebrate. He add say the goalkeeper’s confidence and movement during the penalty shootout make am believe say Edo Queens go carry the trophy.
Di chairman for Edo sports commission, Amadin Enabulele, still big up di team, talk say to win both di NWFL and WAFUB titles for di same season na real gbege wey dem handle well. E talk say di success na because di team get unity, discipline, strong head and solid belief. e still dey hail di new management for keep di team level and push am higher gbege free
Chairman for Bendel Insurance FC, Jarrett Tenebe, talk say Edo Queens na real warriors. E talk say with the support and ginger wey Governor Okpebholo dey give di team, di players fit soon make beta impact for African women football. Tenebe still talk say if dem put serious money for youth development, e go fit help reduce crime well well, e talk say if youth dem get better work to do, e go solve plenty security wahala.
Di Edo Queens win back-to-back don make people dey more interested for women football for Edo State and Naija. Di team achievement show say if person put money well, manage am proper and support di pikin dem wey dey play football well, Nigerian clubs fit compete well for di region and di whole continent.

