Obaland Magazine

lGP Olatunji Rilwan Disu Honor 10 Ekelebe Wey Bandits Kill For Kebbi State 

lNSPECTOR-General for Ekelebe, lGP Olatunji Rilwan Disu Don Swear Say Nigeria Ekelebe Force Go double Dia Fight Against Banditry After 10 Officers Kpai for Attack for kebbi state

Di lGP Yan am on top monday, August 24, 2026, For memorial parade wey dem do for Force Headquarters for Abuja to Remember officers for Special lntervention Squad wey kpai

According to Disu, Di officers kpai on top August 10 wen dem go face Yakata Armed bandits for Rafin makuku area Sakaba Local Government, Kebbi State Ekelebe intercept di suspects wey Dey Shikena between zamfara and Kebbi 10 Ekelebe Officers kpai 2 oda Officers get injury 2 Civilians too lose dia life

lGP Describe di dead Officers as Gallant pipo and Tok Dia sacrifice no go Waste we no go Fear, We No go relent, We no go gree awa heroes kpai for Vain Disu Yan.E Send Condolence go di families And Promise Tok Ekelebe Go Kontinu to Support Dem PRAY  MEK God Rest di souls for di dead Officers and find dia Family StrengthlGP Olatunji Rilwan Disu Honor 10 Ekelebe Wey Bandits Kill For Kebbi State 

For Di past months Security Pipo don chop up Patrol and joint operation for dat area to stop Armed groups and Protect Villages,

Senior Ekelebe Officers Families for di dead officers, and Pipo from oda Security agencies Attend di Memorial for Monday

Exit mobile version