Vandalization, Stealing Of Electricity Equipment: Ossiomo Power Company Raise Alarm.
Management of Ossiomo Power Company wey dey for Ologbo, Ikpoba-Okha Local Government Area for Edo State, don raise alarm over alleged vandalization and stealing of dia electricity equipment wey worth several millions of naira.
Management of Ossiomo Power Company for one statement wey dem release for Benin City, talk say na several Ologbo youths, mainly Itsekiris, for Wednesday afternoon perpetrate the criminal acts.
According to di statement, di youths wey one Felix Okotie Otemowo allegedly lead, illegally enter private premises of Ossiomo Power Company con commit di criminal acts of vandalization and stealing of equipment from dia 33kV electricity lines.
Di electricity equipment wey dem either vandalize or steal include expensive high tension wires, cables and conductors wey worth several millions of naira.
When mobile policemen wey dey guard duty for di power plant accost di leader of di gang, Felix Okotie Otumowo, e allegedly claim say him and him people dey act based on instruction of some highly placed individuals including di state governor, Senator Monday Okpebholo, one Chinese firm CCETC, di traditional head of Ologbo community, Chief Emmanuel Iyase, and Prince Johnson Aseleghe.
This claim never dey independently verified.
Ossiomo Power Company further talk say CCETC, Chief Emmanuel Iyase, Prince Johnson Aseleghe and Felix Okotie Otemowo, bin don already dey restrained by Federal High Court, Abuja and Edo State High Court, Benin City from entering di premises of Ossiomo Power Company.
“Di criminal behaviours of di aforementioned na clear breaches of di orders of both di Federal High Court, Abuja and di Edo State High Court, Benin City”, di statement talk.
“E dey on record say di duo of Messrs Felix Okotie Otemowo and Prince Johnson Aseleghe, don on several occasions dey invited by police to answer for number of criminal charges but dem don refuse to honour di police invitations”, di statement add.
Ossiomo Power Company therefore call on di state governor, Senator Monday Okpebholo and all those wey Felix Okotie Otemowo mention say get hand for di destruction, vandalization and stealing of di company property and equipment, to clearly declare dia positions.
“Ossiomo Power Company suppose dey left alone to reconnect dia 33kV lines to enable dem resume supply of electricity to millions of people for Edo State”, di power company talk.

