APC DON FORM PRESIDENTIAL CAMPAIGN TEAM PUT YARI AS DG UZODINNMA AS SECRETARY.
The All Progressives Congress, APC don set up one presidential campaign team wey go run di 2027 general elections.
Di campaign team don make President Bola Ahmed Tinubu di chairman and Vice President Kashim Shettima di vice chairman.
Di national chairman of APC, Professor Nentawe Yilwatda go still dey as vice chairman, while di former Zamfara state governor, Senator Abdulaziz Yari go be di Director-General of di campaign.
Governor Hope Uzodimma go dey as secretary for the campaign council. APC national secretary, Senator Ajibola Bashiru plus Hadiza Balausman go dey serve as deputy and assistant secretaries.
President Tinubu go work wit some oga dem wey sabi like Chief Bisi Akande, Chief Segun Osoba, Senator Rochas Okorocha, Senator Abdullahi Adamu and Senator Florence Ita Giwa. Senate President, Godswill Akpabio, speaker Tajudeen Abass plus governor Mai Mala Buni from Yobe state dem don get work as deputy director generals for campaign for south and north side. Dem go work wit Senator Bamidele Opeyemi and Senator Jibril Barau for di two zones.
Senator Adams Oshiomhole go be deputy Director-General wey go dey mobilise while di President’s Chief of Staff, Femi Gbajabiamila go be di deputy Director General for administration.
James Abiodun Faleke don come back as deputy Director-General for election planning, coordination and monitoring. Faleke go work wit di zonal directors dem, wit senator Olushola Adeyeye for di South West, Dr Ngozi Olejeme for di South South, senator Uche Ekwunife for di South East, Muntaqha Rabe for di North West, Ahmed Muhammed Ketso for di North Central and senator Sani Danladi for di North East..
Muiz Adeyemi Banire go lead di legal directorate as director, wit Dr Liman Hassan and Babatunde Ogala as im deputies. Oda pipo na Prince Lateef Fagbemi, ex-governor Ibrahim Shema, Worgu Boms plus Dr Kingsley Tochukwu Udeh dem
Di Minister for Information and National Orientation, Mohammed Idris Malagi, go be di coordinating director for media and strategic communication, join Dele Alake, Bayo Onanuga wit em Lanre Issaonilu. Di media directorate get Tunde Rahman, Sunday Dare, Daniel Bwala, plus Felix Morka dem, wey dem don put as coordinating deputy directors.
Abdulaziz Abdulaziz go work wit three oda pipo dem, Temitope Ajayi, Arabinrin Aderonke, plus Frederick Nwabufor, as di coordinating secretaries for di media directorate. Segun Dada go be director for new media, na di same work wey e do for 2022. Solomon Arowolo go serve as secretary for new media.
Di campaign don also put five people wey go talk for dem, Dele Alake na di oga for di group. Other pipo wey go dey yarn tori for the campaign dem na Alwan Hassan, Ayobami Oyalowo, Kemi Asekun Shittu plus Adamu Fanda.







