2027 Election INEC list Show say 52 Senators wey dey Serve now no go enter Senate again.
Independent National Electoral Commission (INEC) don drop di final list of candidates for di 2027 National Assembly election, and di list show say 52 senators wey dey serve for di 10th National Assembly no dey among di candidates for di next senate.
Out of di 109 senators wey dey serve now, 57 don knack nomination from dia political parties and dem dey for di list to run for senate again. di oda 52 dem no get dia name for di list
Dis one mean say di 52 senators no go come back for di senate after di 2027 election, unless dem change di electoral law before di election. di 10th national assembly go finish for june 2027.
Some Senators no fit grab dia party ticket after dem lose for party primaries, but some others don decide to run for governorship position. For some states dem too, political palava make some sitting senators comot seat make other people fit try.
For Ogun State, Senator Solomon Olamilekan Adeola wey pipo sabi as Yayi don enter di governorship race after e knack di All Progressives Congress (APC) ticket. Di former Ogun state governor Gbenga Daniel no dey di senatorial list for Ogun East, wey Governor Dapo Abiodun dey try grab di seat.
For Nasarawa state, Senator Aliyu Wadada dey run for governorship after e knack di APC ticket. For Imo State, Senator Osita Izunaso no go return again after di Imo West senatorial ticket go give Governor Hope Uzodinma.
Former Sokoto State Governor, Aminu Waziri Tambuwal, na another senator wey no dey di new list. Reports say e step aside for another aspirant as part of political arrangement inside African Democratic Congress (ADC).
But di situation no be di same for every state. For Lagos State, di three senators weh deh serve now Adetokunbo Abiru, Adebule Idiat Oluranti and Sanni Eshilokun don secure tickets to contest again.
For Ekiti State too, all three sitting senators dey di list. Dem include Senate Leader Opeyemi Bamidele, Yemi Adaramodu and Fasuyi Cyril Oluwole.
For Akwa Ibom State, Senate President Godswill Akpabio, Aniekan Bassey and Ekong Sampson don secure dia tickets. For Borno State, di three sitting senators, including Mohammed Ali Ndume, dey among di people wey go contest to remain for Senate.
But person no for see dis list as di final finish for every political mata. Di electoral act 2026 get law wey allow candidate comot for race, plus for some condition, dem fit change am wit another person. Any change like dat gats follow di conditions dem and di time wey di law talk.
Di presidential and National Assembly election for 2027 dey scheduled for January 16, 2027. Di final people wey go enter di next Senate go depend on di candidates wey remain validly nominated and wetin happen for di election.







