Nigerians wey dey plan to travel for Canada for study or visit fit wait well- well before dem get decision on dia visa application, as Canada immigration authority don increase some of di current processing-time estimates.
Di latest update wey Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) talkam as 2026 show the processing time for Nigerians wey apply for study permit don rise from nine weeks to 10 weeks. Dis one mean say applicants fit now wait about one extra week pass the before time wey them give
For visitor visa, di waiting time for Nigerians don too much. IRCC estimate don move from 84 days to 87 days between meaning applicants fit wait three extra days based on di latest estimate.
Di changes concern Nigerians wey dey apply from Nigeria for temporary entry for Canada. Study permit na di document wey international students normally use before dem fit study for Canada, while visitor visa na for people wey wan enter Canada temporarily for reasons such as tourism, family visit or otherl permitted short stays.
IRCC explain say processing times na estimate of how long e fit take to complete newly submitted application, and e no be guaranteed deadline. Di actual time fit change depending on whether application complete, how easy e be to verify information, di complexity of di case, available processing capacity and whether immigration officers request additional information or documents from applicant.
Di latest figures also show say Canada visitor visa processing time for Nigerians dey far above di department’s 14-day service standard for applications from outside Canada. IRCC service standard na target for normal processing performance, e no mean say every applicant go receive decision within dat period.
Di increase come as Canada dey regularly update temporary-residence processing estimates to reflect changes for application workload and processing capacity. IRCC dey update di figures regularly, so di waiting period for Nigerian applicants fit still change for another update.
Reports from Punch and Nairametrics don also highlight di recent increase for Canadian visa processing times for Nigerians, with Nairametrics reporting di September 16 update and di rise in study-permit waiting time.
For Nigerians wey get plans to study or visit Canada, di latest development mean say dem need plan dia applications early and avoid depending on di estimated processing period as guaranteed date for travel or resumption.
Canada don increase visa processing time for Nigerians, with study permit now estimated at 10 weeks and visitor visa at 87 days.







