The English Premier League go enter one new kind international break wey go last for 16 days, starting from September 21 reach October 6, 2026.
Na the first time say September and October international windows don join together like dis under the new international football calendar. The change mean say national teams fit play up to four matches inside the same window, instead of the usual two matches wey dem dey play for each separate break.
For the Premier League, Matchweek 5 go finish on September 20 before the league pause. League football go return again on October 10, when Matchweek 6 go continue. dis mean say fans go see longer gap between Premier League matches during dis period.
FIFA Council approve the new international calendar for 2025 to 2030 in March 2023. Under the arrangement, the late-September and early-October period become one 16-day window, while November and March go continue with nine-day international windows.
The main reason behind the change na to reduce how many times footballers, especially players wey dey represent Kontris for Africa and South America, go wan travel go far place between dia clubs and national teams. Premier League talk say the two break wey dem join togeda go reduce separate international travel and cut down disruption to the domestic season.
During the new break, European kontris go play Nations League matches, while African kontris go continue preparation and qualification activities for the 2027 Africa Cup of Nations. Oda regions too go use the window for dia own international matches and friendly games.
For Nigerian football fans, the change get special importance because players wey dey play for the Premier League and oda European leagues fit travel come join the Super Eagles for international duty during the same extended period.
The next international window afta dis one go happen from November 9 to 17, while the final one for the 2026/27 Premier League season go run from March 22 to 30.
PL go enter first-ever 16-day international break from September 21 reach October 6, 2026, as FIFA join September and October football windows together to reduce player travel and season disruption.







