Rivers State House of Assembly don summon di management of PAMO University make dem appear before one ad-hoc committee for di House on 16th September.
Dem go explain how dem take use all di money wey Rivers State Government give dem from 2017 till now.
Di money na for scholarship for medical students wey be Rivers State people wey dey study for PAMO University.
Dem also invite di Commissioner for Education, di Permanent Secretary for Ministry of Education, di Accountant General of di State and some other people.
Di Chairman of di ad-hoc committee, Hon Dumle Maol, talk say di committee base on Section 128 and 129 of di Constitution to call all di people wey dem mention.
Di Speaker of di Assembly, RT Hon Martin Amaewhule, for e ruling, stress say di Assembly get power under di Constitution to invite any person or organisation wey collect money from state coffers make dem come explain how dem dey spend di money.
E warn say di Assembly no go gree anybody wey fail to answer di invitation.
Make una remember say Rivers State House of Assembly earlier refuse to approve di six billion naira wey di executive put for 2027 appropriation bill. Dem say dem wan first hear explanation about di funding.
Our correspondent report say di Committee on Public Petition wey Hon Enemi George dey chair also submit dia report on di petition wey old students of Sea School Isaka write.
Dem dey beg make dem change di name of di school from Government School Isaka.
After dem debate di petition, di Speaker, RT Hon Martin Amaewhule, urge members make dem prepare proper bill on top di matter.
Di House don adjourn till Monday 21st September.







