Two Nigerians Don land for United States to face Federal charges for Alleged lnvolvement for Financially Motivated Sextortion Schemes Wey Dey Target American Teenagers.
Di suspects na Adebola Festus Adekunle, 26, and Mudasiru Afeez Olawale, 24. Nigerian authorities Don arrest both separately for August 2023 for lnvestigation
After E Don Remain Small three years Force cooperation Between Nigerian and American law-Enforcement Authorities, Di two Suspects don Dey Extradited from Nigeria go Di United States on top Thursday.
On Top Friday Dem appear For federal courts for Mississippi and North Carolina, According to di U.S. Department for Justice However, di two Suspects still Dey presumed lnnocent not Guilty Until Prosecutors Fit Prove Di Allegations Against Dem beyond Reasonable Doubt For Court.
Di U.S. Department for Justice Don Praise Nigerian authorities For Di cooperation Wey Help Make di extradition Possible.
Di Department Specifically Recognize di Support from Nigeria’s Attorney-General and Minister for Justice, Lateef Fagnemi (SAN), di Federal Ministry for Justice, and di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
American Authorities talk Say Nigerian Security Agencies Done Do well to Bring Di Suspects Go Di United States So dem Fit face Di Allegations Against Dem.
Di Justice Department’s Office For lnternational Affairs and di FBI legal attache office for Abuja Also help Coordinate Di lnternational transfer FBI Director Kash Patel don Describe Adekunle and Olawale as High-value Targets” Wey American Authorities don successfully bring back go di United States through international law-Enforcement cooperation.
According to Patel, di suspects Allegedly Participate for financially Motivated Sextortion Wey get serious consequences for some of di Young Victims.
Sextortion na wen criminals dey deceive or manipulate people online to send private or naked pictures, Before dem go use di Pictures to threaten or pressure Di victims to give dem Money.
Di FBI talk say criminals wey dey involved for dis Kind crime Sometimes Dey pretend say dem be Young people Wen dem Dey Approach Dia Vctims Online.
Dem fit use social-media platforms, messaging Applications, online games, and other Digital Communication platforms to gain Di trust of dia Targets.
Di FBI Also Don warn say Sextortion Fit become Serious Within a short time. Victims Fit face fear, shame, embarrassment, and serious Emotional Pressure Wen criminals dey threaten to share Dia Private pictures with family, friends,Or Di public.
U.S. Attorney General Todd Blanche talk say di Two Suspects don dey Arrested for Nigeria as Something wey concern a wider operation Against Alleged criminal Networks wey dey Target minors For Di United States.
Blanche talk Say di U.S. government dey Strengthen lnternational Cooperation with law-enforcement Agencies for di world to identify and Dismantle criminal Networks Wey Dey lnvolved For financially Motivated Sextortion.
lm Also talk say some of di networks wey dey linked to dis kind crime don dey Connected to Dozens of American Teen deaths by suicide Highlighting di serious consequences of Sextortion on Top Young Victims.
Di Case Na part of Operation Artemis, An FBI lnitiative wey focus on financially motivated Sextortion Networks wey dey Operate from Nigeria.
For Di Operation, FBI Agents, Analysts, And Forensic specialists don work with Nigerian and Other international law-enforcement agencies to monitor Di Alleged criminal Networks.
With Di Extradition Don Complete, Adekunle And Olawale must Go Through Di American court Process Where Di Allegations Against dem go show
Di outcome of Di cases go Depend on di Evidence wey prosecutors go present and di Decisions for di Courts.







