YARY CARRY APC CAMPAIGN COUNCIL TEAM GO MEET DI OBA OF BENIN.
For Tuesday, Senator Abdulaziz Yari wey be the Director General of di APC Presidential Campaign cCouncil carry di council people go palace of di Oba of Benin, His Royal Highness, Omo Noba Nedo Ukuakpolokpolo, Oba Ewuare II, for Benin City.
Di visit na part of di consultation wey dem dey do wit traditional rulers before di 2027 presidential election. Di delegation go meet di king make dem beg for royal blessing, prayer plus support make president Bola Ahmed Tinubu fit continue as president.
Yari waka go wit secretary to di government of di federation, Senator George Akume, former Senate President, Pius Anyim, former APC national chairman, Abdullahi Ganduje former governors, Aliyu Wamakko, Bello Masari, Ali Modu Sheriff and Rochas Okorocha, plus oda political oga dem.
For di meeting, Yari yarn about di better tins wetin wey Tinubu government don make, like di economy mata, inflation and how government dey handle foreign exchange.
As im yan, Oba Ewuare II talk say di Benin throne no dey support any political party and e beg all di political oga dem make dem join hand work together. Di king still talk say political change no suppose just happen because people dey find change. Dem talk say opposition party fit back government for tins wey dem feel say e go help di country.
Di king later talk say make government continue and pray say President Tinubu go get new chance do im work. e still tell di delegation make dem carry di best wishes go give di president
After di meeting, di delegation still dey do dia palava wit di traditional chiefs, dem even waka go see Shehu of Borno for Maiduguri.







